Hamara Watan Sports National and international
FIFASports

Who qualify for 2026 World Cup and who dey play inter-confederation play-offs

For Africa, DR Congo thrash di Super Eagles of Nigeria to reach Fifa 2026 World Cup inter-confederation play-offs while Portugal and Norway become di latest kontris to book dia places for di tournament.

Plenti kontris don alreadi qualify for di 2026 World Cup while few ones still dey play dia group qualifiers game.

Na total of 32 teams don dey sure of dia place for di 2026 World Cup including England, Croatia, France, Argentina and World Cup first-timers Cape Verde, Jordan and Uzbekistan.

Howeva, e still get 16 spots wey some kontris still need to fill wit di majority dey come from Europe.

DR Congo na di latest of di six kontris wey go play di inter-confederation play-offs to extend dia bid to reach di 2026 Fifa World Cup.

Which kontris don qualify for World Cup inter-confederation play-offs

Di DRC beat Nigeria 4-3 on penalties afta 1-1 draw for di African playoff final.

Meanwhile, Nigeria go miss from a second successive edition of di World Cup afta a poor performance for Rabat.

Na three kontris don progress to di play-off and dem go battle am out for di next stage.

Although dis kontris neva qualify for di tournament in full but dem don confam to take part for di inter-confederation play-offs for March 2026.

Di teams wey remain na two teams from Central America, and one from Asia to qualify for Play-offs.

Teams wey go through to 2026 World Cup

Wales still get chance of finishing top of Group J but go need to beat North Macedonia and hope Belgium lose to Liechtenstein for dia home for di final Group J game.

Switzerland, di Netherlands and Spain go all book dia places no mata di defeats and huge goal difference.

Joint-hosts Canada, Mexico and di United States get automatic qualification.

Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea and Uzbekistan don alreadi qualify from Asia.

Oceania get one direct qualification spot and New Zealand don take am.

Tunisia and Morocco na di first two African sides to go through to di World Cup, and Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Senegal and South Africa join dem.

Brazil, Ecuador, Uruguay, Paraguay and Colombia na di oda South American nations wey don guarantee dia place.

Hosts: Canada, Mexico, United States

Africa: Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Morocco, Senegal, South Africa, Tunisia

Asia: Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea, Uzbekistan

Europe: Croatia, England, France, Norway, Portugal

Oceania: New Zealand

South America: Argentina, Brazil, Colombia, Ecuador, Paraguay, Uruguay

World Cup trophy

Wia dis foto come from,Getty Images

Wetin we call dis foto,Di 2026 World Cup go take place for Canada, Mexico and di United States from 11 June to 19 July

How does World Cup qualifying work?

Each of Fifa six confederations use different methods of qualification to determine which nations qualify for di World Cup.

Oceania na di only continent to complete dia direct qualification process for next year World Cup.

Of di 48 teams for di 2026 tournament, dem give three places to di host nations and 43 go earn dia spot through direct qualification from di six confederations.

Di oda two spots go dey determined by intercontinental play-offs.

Europe

Qualifying places: 16

Teams already through: Croatia, England, France, Norway, Portugal

Teams guaranteed play-off (at least) through qualifying: Germany/Slovakia, Switzerland/Kosovo, Denmark/Scotland, Spain/Turkey, Republic of Ireland, Netherlands/Poland, Austria/Bosnia, Italy.

E get 12 groups and di winners of each go qualify for di World Cup.

Europe na di only continent wey no get any team for di intercontinental play-offs.

Qualifying game bin start for March 2025 – wit some teams not even playing dia first qualifiers until September sake of di Nations League.

Di group stages go end dis week, while di play-offs go start for March 2026.

Scotland gatz beat Denmark at home to qualify automatically, odawise di Danes go go through instead.

Belgium were held to a surprise draw by Kazakhstan on Saturday and will guarantee their spot if they beat Liechtenstein, who have not scored a goal in Group J, in their final game.

Di Netherlands just need point at home to Lithuania to dey sure of qualification, but even if dem lose, Poland go need to win for Malta wit goal difference swing of 13 goals.

Austria go play Bosnia-Herzegovina for dia final group game on Tuesday, wit di winner securing top spot and a place for di World Cup. A draw go also dey enough for Austria.

Spain host second-placed Turkey for dia final group game and dey currently three points clear wit superior goal difference.

Germany need one point against Slovakia for dia to go through, but di Slovaks go top di group if dem win.

Switzerland go qualify if dem draw or beat Kosovo for dia final group game. Even a defeat dey likely to dey enough becos of dia superior goal difference.

South America

Vinicius Jr and Bruno Guimaraes celebrate for Brazil

Wia dis foto come from,Getty Images

Wetin we call dis foto,Brazil na di only nation to play for evri World Cup for di competition history

Qualifying places: Six, plus one into intercontinental play-offs

Teams already through: Argentina, Brazil, Colombia, Ecuador, Paraguay, Uruguay

Intercontinental play-offs: Bolivia

South American 10 teams play 18 games each, and di process start for September 2023.

Di top six all reach di World Cup, wit di side wey dey seventh place go into di intercontinental play-offs.

Wit group qualifying now ova, Bolivia beat Brazil 1-0 for di final round of games to reach di intercontinental play-offs.

Asia

Qualifying places: Eight, plus one into intercontinental play-offs

Teams already through: Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea, Uzbekistan

Asian qualifying game start for October 2023 wit di lower-ranked teams in action.

For di third round, di top two teams for three different groups qualify automatically.

Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea and Uzbekistan don secure dia places.

One oda side go progress through di intercontinental play-offs, wey follow Asia play-off for November.

Dat na between UAE and Iraq – wey draw dia first leg 1-1.

Africa

Qualifying places: Nine, plus one into intercontinental play-offs

Teams already through: Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Morocco, Senegal, South Africa, Tunisia

Intercontinental play-offs: DR Congo

E get nine African groups of World Cup qualifiers, each wit six teams, wey start for November 2023.

Di top team from each group go through automatically – wia Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Morocco, Senegal, South Africa and Tunisia guarantee dia places.

Di best four runners-up go into play-offs for November for di chance to earn dia spot for di intercontinental play-offs.

DR Congo beat Nigeria for di final.

North, Central American and Caribbean

Mauricio Pochettino looks on

Wia dis foto come from,Getty Images

Wetin we call dis foto,Mauricio Pochettino go lead di United States for dia first World Cup as a host nation since 1994

Qualifying places: Six (including three hosts), plus two into intercontinental play-offs

Teams already through: None through qualifying – Canada, Mexico and United States automatically as co-hosts

Di Concacaf qualifier get different look to usual, as three of dia biggest hitters no dey involved as dem don qualify as hosts, but plenti spots still dey.

Twelve teams dey involved for di third round of qualifier wey start dis month.

Di winners of each group go to di World Cup and di two best-ranked runners-up going into di intercontinental play-offs.

Suriname, Curacao and Honduras currently lead di three groups wit one round of games to go.

Oceania

Qualifying places: One, plus one nation into intercontinental play-offs

Teams already through: New Zealand

Oceania qualifier don alreadi end – wit New Zealand beating New Caledonia 3-0 for di final.

New Zealand go through to di World Cup automatically, as a result of di expanded World Cup. Oceania usually only get a play-off spot.

New Caledonia go take part for intercontinental play-offs for March 2026 – featuring teams from Africa, Asia, South America and North America – wit two out of six teams going through.

Related posts

We’re all behind him’: Dockers back under-fire coach

M.Naveed

Madushanka in record books with hat-trick against Zimbabwe

M.Naveed

Rohit Sharma joins Virat Kohli in T20I retirement after World Cup win

M.Naveed

Leave a Comment